I use to think about this often too 🀣🀣

.

Like this now, one day one day, I will bring one man wey I no know from genesis to tell my mama say me and am wan marry πŸ™„πŸ˜‚. Ya bα»₯, "mummy, this is the man that wants to MARRY me". Shebi nah so dem dey talk am πŸ€”
How unah dey even keep mouth when telling your family this? πŸ€”πŸ€”

Like, this man is my husband-to-be. From where? How? Onye ebe?

Nsogbu πŸ™ƒ

"You may now kiss your bride." Kiss keeeee πŸ˜‚πŸ˜‚, ọga abeg I no do 🀣🀣. I go fess burst out dey laugh πŸ˜‚ or even cry 😭.
Somebody should show me the way oooooo πŸ˜€.Β 
Abeg make unah pass me past question papers πŸ˜…

And I will later pack all my properties to go and live with him, like start living my entire life with a total stranger, dey call am my husband, dey do one and two with am for the rest of our stay here πŸ˜‚πŸ˜‚

I go shaa miss my papa house ooooo πŸ™†β€β™€οΈπŸ™†β€β™€οΈ

Shame go first wear me agbada for a few months of that marriage ooooo πŸ˜‚. That man fit dey stressed out in one week from my drama. No fear, no be bad drama. I can explain 😩🀲; I fit go hide for inside toilet for the whole day 😎.

How unah dey do this thing abeg?

O chim πŸ€¦β€β™€οΈΒ 

So you people are telling me I will sleep in the same bed with someone and wake up in the morning to see him beside me and it will no longer be a sin? πŸ™ˆΒ 
Someone I will be asking "what are we cooking today", "how do we do this", premium gist, endless sweet wahala pro max everyday 😝😝.

Like, among all the cute and able men in the whole universe, I will end up with just one lucky 😎 person as mine and mine alone? Mα»₯a, IFEBUCHECHUKWU will be the only woman who has full and complete access to his entire being and the key to his control unit πŸ˜‹. I will call him Obim and he will call me Ềtọm πŸ˜πŸ˜†

Chaiiii, me self no small oooooo πŸ˜ƒπŸ˜„

But before then, how unah dey even maintain a relationship or even talking stage for a straight one week and still keep the momentum and velocity? 😩
E be like say I go need study this thing like a course in higher institution.

.

Another thing now, in few years time, one small pikin go dey call me mummy 😚😚. Me wey no know my left from my right. Abi nah me wey no serious with my life go mummy someone πŸ˜‚πŸ˜‚. I just dey laugh myself as I dey reason this πŸ˜‚πŸ€£

God abeg oooooo πŸ˜…
Into Your Hands I rest this case πŸ™‚

Happy Celebration of St. Valentine. One Love 🧑