CHAPTER 1
Sometimes life just dey play wayo with person.You go think you've seen it all,until one fine day you meet somebody wey scatter your whole definition of "friend."That was how I met Precious my stubborn,caring,crazy fine guy friend wey later become my gist partner,my fight partner,and my favorite person for my hood.
It all started through my friend BK.That day,BK just stroll come my side with him loud voice:
"Ifyy, you too dey dull!Make i carry you go meet one guy wey dey sell phone and laptop for junction.Him sabi business and him sabi play.You two go click.”
Me l just laugh,because BK always dey matchmake people sometimes business,sometimes friends hip,sometimes wahala.But that day,I follow am go.Na so I meet Prince.
Prince stand for front of him small shop that day,white polo,black jean,clean haircut.He hold one i Phone like say e be king of gadgets.The guy fine ehn that kind fine wey make you form seriousness before you forget yourself.But he get this proud aura not rude,just that type of confidence wey co me naturally when person sabi him worth.
He look me once and smile small.
"Na you BK talk about?"he ask.
l answer,“Maybe.”
He laugh."You get mouth o.You go stress person."
Na from that day wahala start.

















